Owa

4 views

Lyrics

Ey, ey, ey, ey, ey, ey
 Uhn, uhn, uhn, uhn, uhn, uhn
 Kill person for there
 Oh, what she go chop? (Chillz made it)
 Oh, baby dey kpai
 (Ah!)
 Na so dem dey do (oh no, no-no)
 Pack everybody like sardine (sardine)
 We dey gallivant up and down
 Forget say body no be machine (say body no be machine)
 All the tax wey we generate (oh no-no)
 Why the cash no dey circulate?
 And when we start to calculate
 Everybody come dey agitate
 Ojota, o wa oh, oh-
 Owa o, o wa
 Agege, o wa oh
 Owa o, o wa
 Ojota o, o wa
 Owa o, o wa
 Agege, o wa
 Owa o, o wa
 Give me mineral, pass me the Gala
 Hustle critical, we no fit retire
 O jo cinema
 E don turn wahala
 Many animal dey put on agbada
 I get medicine, wey dey cure anything
 E dey cure poverty
 Bring prosperity
 Many things (many things)
 Many things (many things)
 Everyday, we dey see many things
 Because it's a critical reaction
 Kai, my country no get formation
 Olohun, for your information
 Population dey for prostitution
 I say dem mama, dem papa, dem dey cry (oh no)
 Dem no know how pikin dey kpai
 Money no dey, he dey drink kai-kai
 Kai, haba, baba na
 Ojota, o wa oh-oh-oh
 Owa o, o wa (dem dey kill person)
 Agege, o wa
 Owa o, o wa
 Ojota (Ojota o), o wa
 Owa o, o wa (owa, o wa oh-oh, eh)
 Agege, o wa (oh lo-lo-lo)
 Owa o, owa (eh, ye, ye, ye-ye-ye-ye)
 Give me mineral, pass me the Gala
 See, I know Sikira, she don hustle tire
 The way she dey work, suppose wear designer
 But, she no be baller, she no know Dybala
 I talk my own, I don dey go
 Conductor own, he stop for road o
 You get money, you chop alone
 You run belle, you purge alone o
 Why you no give me change? I para (chei! Dem dey do us ojoro o)
 I curse the driver, I tell conductor say waka (dem dey do us ojoro o)
 Stop the motor, I need to come down, I tire (dem dey do us ojoro o)
 Poto-poto, everything e scatter
 We dey face wahala (dem dey do us ojoro o)
 Ojota, o wa
 Owa o, o wa (owa, owa ooh)
 Agege, o wa
 Owa o, owa (owa, owa se e)
 Ojota, o wa
 Owa o, o wa
 Agege, o wa
 Owa o, o wa
 

Audio Features

Song Details

Duration
02:53
Key
11
Tempo
101 BPM

Share

More Songs by Falz

Albums by Falz

Similar Songs