Disrupt the Programme

4 views

Lyrics

Freedom, freedom, freedom
 We must to disrupt the programme
 Put sand sand for their gari
 Regain our freedom by any means necessary
 Disrupt the programme
 Put sand sand for their gari
 Regain our freedom by any means necessary
 Oga no tell me say make I hold my anger
 Make I no make noise make I cooli temper
 When herdsmen dey slaughter, massacre we brother
 From Benue, Ekiti, Enugu, Zamfara
 Hundreds dey die dey peme like fly
 Blood e dey flow government dey turn eye
 Silent indifference dem go play with our sense
 Point hand for Libya to bury di matter
 We must to disrupt the programme
 Put sand sand for their gari
 Regain our freedom by any means necessary
 Disrupt the programme
 Put sand sand for their gari
 Regain our freedom by any means necessary
 How long we go dey wait dey sit down debate
 Dey waste our saliva dey yan for social media
 Nothing go change if we no organise
 Call out their bullshit and cut them to size
 Na we get di strength na we get di numbers
 Nothing to fear my brother rise up my sisters
 By vote or by force we must wipe di slate clean
 This yẹyẹ politirikshians must enter dustbin
 We must to disrupt the programme
 Put sand sand for their gari
 Regain our freedom by any means necessary
 Disrupt the programme
 Put sand sand for their gari
 Regain our freedom by any means necessary
 Freedom – The clock is ticking
 Freedom – It's all or nothing
 Freedom – Don't come for begging
 Freedom – Stand for something
 Freedom – It's all or nothing
 Freedom – The clock is ticking
 Freedom – We done with talking
 Freedom – Just stand for something

Audio Features

Song Details

Duration
04:00
Key
9
Tempo
119 BPM

Share

More Songs by BANTU

Similar Songs