My Car

Lyrics

Tetu, where you dey go
 Wetin you dey go
 Wetin you dey find
 Why u dey ask me that kind question
 Say where I dey go
 You don hit my car, oyinbo repete
 I say, you don bash my car, gbese repete
 Tell me, you don hit my car, oyinbo repete
 As you don bash my car, gbese repete
 Wetin you dey find
 Where you dey go
 As I dey walka dey go like so
 Me, I am looking for this paddy
 This paddy owe me plenty money
 They tell me say they dey ikoy
 Me I get (yidis) for one party
 Seri Paddy yen, ofe pa mi
 Today na today, no time for story
 Tinba dele re, Ti n gba mu
 He must pay me all the money
 I come reach him say
 I come see say
 People gather dey just dey cry
 I try to know wetin cause the cry
 They tell me say my paddy don pai
 As I con dey go back to my house
 I come meet small hold up for road
 The next thing wey I hear for my back
 Na one scratch from another car
 Ehn Ehn
 You don hit my car, oyinbo repete
 I say, you don bash my car, gbese repete
 Tell me, you don hit my car, oyinbo repete
 As you don bash my car, gbese repete
 See, me see trouble ooh, another day again
 Dead body no dey pay person money
 Another paddy don dey bash my car
 Today na today, no time for story
 Ah, Eedris, na u, see wahala
 Hey, whatsup, Tony, whatsup man
 Ebe long time, wey no see, whatsup man
 Ol boy, stop that yarn o
 Wetin be whatsup
 You bash my car, you dey tell me say whatsup
 Shey na whatsup I go use spray my car
 I beg pay me my money
 Police con come dey measure the line
 They say make I no worry, everything go be fine
 They turn the papers say I make sign
 I sign my own, Eedris sign im own
 I con dey whether who get the fault
 They say na my paddy get the fault o
 I pack my car, see trouble
 Yanga dey sleep, trouble come wake am
 He he
 You don hit my car, oyinbo repete
 I say, you don bash my car, gbese repete
 Tell me, you don hit my car, oyinbo repete
 As you don bash my car, gbese repete
 Huhh
 Somebody o, somebody wey
 You don kissin ni, bobon kolo
 Shey na girigiri you dey take drive car
 Shey is good
 Somebody wey were, bobon kolo fit kolo
 Begin dey drive car ka kai kai
 Don kolo, girigiri
 Another wahala to carry for head
 Money no dey pocket for man to spend
 One of my paddy wey dey owe me money
 I reach im house, they say he don pai
 Another don dey bash my car
 Wetin I go do, e no get money
 I con think say this stress no worth am
 Today be na own, tomorrow fit be my own
 I go tell my paddy
 Make he come dey go
 Help me to push my car from road
 As I push am small, wetin I see
 Na government car come bash my car
 Again
 You don hit my car, oyinbo repete
 I say, you don bash my car, gbese repete
 Tell me, you don hit my car, oyinbo repete
 My own don better o, owo repete
 You don hit my car, oyinbo repete
 My own don better o, owo repete
 Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete
 My own don better o, owo repete
 Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete
 My own don better o, owo repete
 Tinubu, you don hit my car, oyinbo repete
 

Audio Features

Song Details

Duration
04:08
Key
7
Tempo
110 BPM

Share

More Songs by Tony Tetuila

Similar Songs