Many Things

4 views

Lyrics

I don hear many things (Many things)
 I don see many things (Many things)
 Wey make me think many things (Many things)
 Wey tire me pass anything (Many things)
 As time dey go (As time dey go)
 Things dey spoil more and more (As time dey go)
 As time dey go (As time dey go)
 Children dey die more and more (As time dey go)
 No food to eat (As time dey go)
 No light to see (As time dey go)
 No water to drink (As time dey go)
 Nowhere to stay (As time dey go)
 I don hear many things (Many things)
 I don see many things (Many things)
 Wey make me think many things (Many things)
 Wey tire me pass anything (Many things)
 When I see the way my people dey
 live, under bridge and on top of water
 When I hear the nonsense things, nonsense things our leaders dey do
 When I see the oga of police in prison for stealing
 When I hear education minister in scandal for stealing
 When I see our senators, throw chair pull agbada
 When I see our senators, throwing chairs just to share money
 Dem go share the billions, wey dem suppose take feed the people
 Dem go share the billions, wey dem suppose take help the people
 I don hear many things (Many things)
 I don see many things (Many things)
 Wey make me think many things (Many things)
 Wey tire me pass anything (Many things)
 When you turn television, and you listen to the radio
 When you turn television, and you listen to the radio
 You go see the things them do, you go hear the things them say
 You go see the things them do, you go hear the things them say
 You go see the corruption (Lo ri si ri si)
 You go see the inflation (Lo ri si ri si)
 You go see the suffering (Lo ri si ri si)
 Suffering of the people (Lo ri si ri si)
 Ahh, lo ri si ri si (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, stealing (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, killing (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, shooting (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, movement (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, government (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, party (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, system (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, cheating (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, killing (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, shooting (Lo ri si ri si)
 Ori si ri si, government (Lo ri si ri si)
 I don hear many things (Many things)
 I don see many things (Many things)
 Wey make me think many things (Many things)
 Wey tire me pass anything (Many things)

Audio Features

Song Details

Duration
08:03
Key
5
Tempo
96 BPM

Share

More Songs by Seun Kuti

Similar Songs