Motherland

3 views

Lyrics

Sound sultan, naija ninja
 Kennis Music
 Na for all ma brothers wey don ja commot for naija
 always try to dey look back because there's no place like home
 Yknawmean?
 Yoruba man tell me say Ajo o dabi ile
 And na true men
 Check this out
 Ajo o dabi ile
 No matter where u go
 make u no forget area o area o
 Na naija
 Ti ode ba tile
 Pada wale o wale o
 How I wish say I fit reach u anywhere u dey, u dey
 Far away, that one no say make u dey bone area o
 Mother landi o
 na your area o
 Chinedu somebody borrow you ego
 Make you take travel go chicago
 Remember Nnamdi sell him car
 So you go go America
 All these people wey bin dey raise you
 still dey stay for face me i face you
 promise say u no go fashie them
 every other month u go dey tashi them
 Hillary wey u been promise to marry
 Still dey wait ol boy she don tarry
 When she see u na inside Ovation
 You marry Oyinbo from another nation
 Use mago mago get dough
 Now your Oyinbo wife don't know
 next thing you know she don go report you
 Wetin you know them don deport you
 You been say na one year
 E come turn to two years
 You don go for seven years
 But You dey serve eleven years
 Even when your papa pai
 Plus the tears your mama cry
 Bayo for chicago o
 Dem dey miss you for Okoko o
 Biodun for Canada
 Your mama still dey wonder
 Igba wo lo to ma pada o
 Remember for naija you get iyawo
 Ko dabi ile (5 times)
 Ajo o ma dabi ile o
 You say u go call
 Everybody wait tire for your call
 Rote o, why u go like so o?
 From germany, to carry coco enter Yankee
 but then coco burst for your bele
 Rest in peace.
 You fly away
 How come one day wey fun dey u fit come backi o
 Your papa landi o
 I understand sey u been so far away
 Long long way from home (4 times)
 You got a long long way from your papa land
 Think before u enter that plane
 All ma brothers in the west, south, east, north south
 U know how we doing it
 And all these people wey dey rule us
 Make una try make naija sweet
 Make we get water, light e.tc.
 So that people go dey come house
 Kennis Music
 All the cardinal points
 Respect
 All ma people in da house

Audio Features

Song Details

Duration
03:29
Key
10
Tempo
82 BPM

Share

More Songs by Sound Sultan

Similar Songs